[Lyrics] Erigga Ft. Duncan Mighty – Jollof Rice - Khorgist.com

Breaking

Post Top Ad

Advertise Here

Post Top Ad

STAY SAFE




Saturday 22 August 2020

[Lyrics] Erigga Ft. Duncan Mighty – Jollof Rice

 

LYRICS

Duncan Mighty

Eriggaaaaaa!

Wene Eriggaaaaaaa!

Aeroplane no get advert oh for television

Because the people when fit buy am no

Fit tune just dey watch tv

Its PH and Warri

Abeg!


On the beat its C-Major


[Verse 1 Erigga]

Why your eyes dey red, you don smoke again?

Where Benz, where your chain, you don broke again?

Burna Boy na your guy, why you no sing with am?

You be upcoming? Why TV no dey slam your jam ?


Why you build house for area why you no stay EKO?

(Ewolewo oniovo wogbiwegho ?)


Your followers for IG dem Never reach 1m ?

Weytin be your problem, Emirate no solve them?


Why no dey shoot videos like Wizzy own?

Or buy better motor like dem Drizzy own?

Work with David you no wan blow like AD (Victor AD)

We be your fans we need see you for TV steady


We love your tweet but Why you no like giveaway?

Even if na 5, 5 k your woman never pay

No be you sing motivation motivate us

If I continue we no go see where put chorus


[Chorus – Duncan Mighty]

I no be Jollof Rice

I can’t please everybody oh

Yea baa

I no be Jollof Rice

And I can’t please everybody oh


I no be Jollof Rice

I can’t please everybody oh

(****)


Hook

I know that my Spag is another man poison

Another man belle is the other man toilet


[Verse 2 – Erigga]

Erigga no dey form sorry for me

I be your brother ooo if na 5m run am for me

Why no dey pick my calls or reply Whatsapp?

I be your half sister no dey behave like that


We hear say you come Area, Why you no visit?

Papa dey vex, if e dey call your number busy

No be so oh, na here all of us take grow

You blow finish no come dey regard us Oko


I no fool oh that years when I de zuzzu

Many no gree look my face I be pupu

No be Nunu if to say hope never die

Na him for dey here dey relate you real matter


If I open mouth tell you weyrin play for Lagos

Erigga live matters go start, Industry go burst

But look my life Oko, you dey God Hand work

E better blow Area know wayrin I dey talk .. Real matter


[Chorus – Duncan Mighty]

I no be Jollof Rice

I can’t please everybody oh

Yea baa

I no be Jollof Rice

And I can’t please everybody oh


I no be Jollof Rice

I can’t please everybody oh

(****)


[Verse 3 – Erigga]

My mama say Jesu gworu ki father

I no fit kill myself Oko turn powda

For my neck I need to celebrate my self

I don try even Headies never dey my shelf


You no fit please everybody you no be Jollof rice

Read your bible Peter loose guard Jesus Christ

Upon the way them tight reach, e deny am thrice

The reason I drop this song na make area for wise


Even this Hushpuppi matter don make me understand

Say Na all man for self 2face talk am naw

You like do giveaway from now till next year

The minute your hand cold area go kpelebe


If I dey do for you, no feel say wise

I no be fool, Naturally I dey nice

From now on na do for who do for you

No Involve yourself if dem no involve you too


[Hook (outro)]

I know my Spag is another man man poison

Another man belle is another man toilet


Its No Limit


The End!!!

No comments:

Read Comment Policy ▼
PLEASE NOTE:
We have Zero Tolerance to Spam. Chessy Comments and Comments with Links will be deleted immediately upon our review.

Post a Comment

Post Top Ad




Do you ever witness news or have a story that should be featured on Khorgist ?
Submit your stories, pictures and videos to us now via WhatsApp: +2347064258615, Social Media @khorgist_com: Email: Khorgist@gmail.com More information here.